CAF don come again oo, match wey Edo Queens of Nigeria win, CAF don come out tok say dem go play am again.

Incase you no know, Edo Queens of Nigeria vs Ampem Darkoa of Ghana bin play WAFU Zone B qualifying final for di 2026 CAF Women’s Champions League( asin anybody wey life di trophy go qualify for CAF w0men’s Champions League).

Dem play 2-2 for 90 mins naso referee tell dem say make dem go play penalty shootout, as dem play penalty shootout naso Edo Queens win 4-1 wey give dem di trophy and Champions League ticket.

After di match Ampem Darkoa go report say after di match say dem suppose play extra time but referee carry dem go penalty direct.

As dem report finish, CAF come tok say na true oo say dem suppose play extra time, Ampem Darkoa come tok say make dem start di match afresh.

CAF say No, say di 90 mins result go stand but wetin dem go do be say dem go start di match from extra time.

So dem go announce di new date and kick time again, my people Weytin we go call this one again ?