Menu
5
Nigeria

BEFORE YOU CALL WE NIGERIANS LAZY

Post image
Eni just dey open mouth call youth lazy. 
Some of these same youth dey leave house 4:30am. Dem dey come back 11pm. Some dey do remote work, some dey sell, some dey teach, some dey carry cement. Still, rent dey rise, food dey expensive, opportunity dey scarce.
E easy to talk when you already get soft landing. When your path clear, you go just dey advise people wey still dey find road.
Nobody say hard work no important. But make we stop pretending say the system equal for everybody. Some people dey try, but the result no just dey show.
Before you call them lazy…
First understand the weight dem dey carry.