Sometimes, I wonder if some people really understand wetin average Nigerian youth dey go through.

People wake up every morning, go through traffic, enter one China company or another, work under conditions wey no even encourage human being, spend almost their whole day working, come back house tired, and still wake up the next morning to continue the same struggle.

Some people dey hustle from morning till night, some dey do two or three jobs, some never even chop properly, yet dem no give up.

So when you come out to tell young people say dem no wan work, say dem dey complain too much or say life never show dem anything at 20, e make sense to ask: which Nigeria you dey live in?

No be everybody get the same opportunities. No be everybody get family wey fit support dem. No be everybody get connections or financial backing.

Hard work is important, nobody dey deny that. But make we no use hard work take invalidate people's struggles. Sometimes, people no need motivational speeches; dem need opportunities, fair wages, better working conditions and a society wey no go make survival look like punishment.

Because honestly, some Nigerian youths no be lazy. Dey are simply tired of struggling without seeing the reward of their labour.